Advertisement - Continue Reading Below

Pidgin Love Poems for You to Share with the One You Love

Here are the best collections of Pidgin Love Poems for You to Share with the One You Love.

Best Pidgin Love Poems for You to Share with the One You Love

Love na better thing. If you get the one wey dey give you joy. These Pidgin Love Poems For You To Share With The One You Love na wetin you need to send to your special sombodi. Make you no take love play. The person wey dey give you peace of mind deserves the best from you.

Make you take this we Naija love poems should love to your sweetheart. Last last, this for sure go make your person love you forever. Your personal person na the one wey dey give you joy. Na the person wey him love dey totori your head. We thought of you with these collections of some Nigeria pidgin language love poems and we want you to take some funny romantic steps and send these totori love poems to your correct person.

Naija Pidgin Love Poems. These romantic poems na better matter wey go make your person begin to show you love like you never see am before. Heart Touching Poetry, Beautiful Love Poems and Special Romantic Poems

The Thing I Hide From You

Something wey I dey hide inside my heart
Na the matter I want talk about today
This feeling of you nothing go fit stop am
I don try make him stop to worry my mind
But the more I dey try, na so I still dey see am.

This na love I know say I dey feel for you
For you I no go search for another again
Na you be the correct person wey I like
Better love wey go make me stop to search
And forever I want to live for you.

You make me fall in love like never before
If I sleep na you I want see for my dream
And if I wake up still na you I want to see
You steady me with all the things you do
This love wey you dey give me na final.

Today make I tell you one thing wey be true
This thing wey I don dey hide from you since
Na you be the Angle wey dey comfort my heart
And since wey I start to fall in love with you
The different don clear pass Seven-Up.

Nsikak Andrew

Love Poem in Nigerian  Pidgin. There is nothing wey fit make you feel better like the love of that special person you care about. When you feel loved, you have it at a go to do all it takes to make that love feel so special. If you have gotten that special person in your life, make you no play with am o. Abeg, send this romantic totori poem make your person feel happy like tomorrow no dey. Happy Birthday Wishes and Messages for a Woman of Important Personality

Romantic Pidgin Love Poems

I Dey Feel Your Love

Na your love
I dey feel inside my heart
And the matter
No let me sleep for night
If you search my heart
Na your love dey reign
And if you think say na lie
Abeg look inside my eyes
Na there you go see
Say na true talk I dey talk.

I don search many places
But I never see the love
Wey be like your own
You correct no be lie I talk
Na your love dey give me joy
Everytime I think of you.

Na you be the person for me
And your love be the thing
Wey dey make me happy
You be better treasure
Wey I want to keep forever.

Every morning you be
The first person wey I want see
Every afternoon you be
The Sun wey I want
Make him shine on me
Every evening, I want your love
Make him cool my heart
Everyday na you I want
Make him be my true love.

Nsikak Andrew

Romantic Naija Love Poem. I am still in that Nigerian romantic mood. What more than to give you some taste of real Naija romantic poem in the language that will make your love interest go ever gaga for you. This love na wetin go make your person head scatter with sweet feelings of thinking about you all the time. If you understood how it feels like to be in love; doing some crazy positive things for the sake of it then you would know that loving someone and that person loving you back goes a long way to make things much easier. Enjoy these Naija love poems! Poems about Marriage and Love

You Dey Make Me Smile

When I got to sleep at night
All I long for na to hold you
Inside my arms till the morning
I want to be around you
Every moment and all the time
Na the thing wey dey give me joy.

In the morning
All I want to see
Na you my sunshine
You dey totori my heart
And make me feel anew
This your love na better thing
Wey do happen to me.

A thousand mile
Be like one day
Every time I see you
If no be you
I for never know say
Love sweet pass sugarcane.

You be my ever true love
The one wey dey make me smile
My correct better person
Wey dey give me joy back-to-back
If no be you na no one else.

Na you dey make me smile
Still na you dey make me cry
With love that makes me laugh
This our love na Five and Six
Nothing will separate us till forever. 

Nsikak Andrew

Romantic Love Poem in Nigeria Pidgin Language. Will you be bold enough to declare your love for that special person? If you dey shy, abeg make e stop. If you are still alive, there is nothing wey go make you escape love. Love na one wonderful thing that makes life go round. If you are in love, this touching naija romantic poem is for the special person in your life. Go all out and express yourself without reservation if you have found that special somebody. Valentine Love Messages for Husband, Wife and the One You Love

Best Romantic Pidgin Love Poems

If No Be You

If no be you
Then there is no other
Na you be
The correct person for me
Every time you call
I go dey run back to you
For you I go fit do anything
Just to see you smile.

Make them talk
Me I no send
I wish them know
This love wey I feel for you
Them for no dey talk anyhow
You be my personal person
The one wey dey make me happy.

If no be you
Water for don pass Garri
You steady me
When nobody believe
You open my eyes
When I still dey doubt
If true love exists.

Today
You don turn my doubt
And make me see
The meaning of true love
My Hero, my Champion
You are my better love
Wey I no fit let go
For if no be you
I for think say love na lie.

Nsikak Andrew

Naija Pidgin Romantic Poems For The One You Love. Na the one you love supposed to be your everyday happy love tonic. The person supposed to give you joy. If you have gotten that soulmate, come share these Nigerian pidgin love messages and romantic love poems with that sweet soul of yours. The happy love tonic and I want to be there for you is something wey go make the heart jolly like nothing dey happen. Short Romantic Text Messages for Someone Special

My Love Tonic

Two heart wey dey beat as one
That the thing wey dey make
My heart dey happy like no tomorrow.

You dey give me too much love
Wey come dey make me jealous
Like say na dream I dey dream.

My happy love tonic
Na you be my ego
The better thing wey be my own.

I love you that no be lie
I got do anything for you
That is the simple truth.

If love be person
Na you be that person
My better love tonic.

I go always dey here for you
As you don make me fall in love
You be the one wey no get equal.

By Nsikak Andrew

Pidgin English Romantic Love Poem. It is always good to be right there for the one you love. Standing together and overcoming all challenges together would always make that soulmate of yours to be so proud of you anytime, any day. Inspire love with this sweet Nigeria love poem. This na better matter for the person wey dey give you joy. If you care for that your sweetest heart, this naija way romantic poem na wey thing you personal person need. Sweet Romantic Love SMS for Your Sweetheart

Today And Always 

I want to be there
Just for you
I want to be there
Right by your side
I just want to be there
To be close to you
I want to be with you
Just like your shadow.

Today and always
I just want to be there for you
To hold you close to my heart
And smile into your face
To make you feel the comfort
That would reassure you of my love.

I want to be there for you
Like every rising of the sun
I want to be your one and only
The very true love you can cherish
To keep, to admire and to adore
I just want to be there for you
If that is all I have to do for love
I just want to be your true love.

Nsikak Andrew

Naija Romantic Pidgin Love Poem. Love na the main thing. If you are in love you would always find it rewarding to share the sweet romantic experience. Naija na the country of happy people and here our love make sense die. Be inspired with our Naija way of expressing love with this Pidgin love poem in English language. If you still dey with your better sweet heart, make you send am this tears for love romantic Naija pidgin poem. Merry Christmas Greetings, Messages, Quotes and Wishes for the People You Love

I Love You

I love you, I love you
No be for mouth
Man wey no get money
Wetin woman want take am do
Abeg na who sent poor man.

The guy is good, the Bobo correct
Na him pocket make am o
Soup wey sweet, na money kill am
Woman wey fine, na change make am-o!

I love you, I love you,
No be for mouth
Something dey inside-o!

Nsikak Andrew

COMMENTS

Advertisement - Continue Reading Below
Advertisement - Continue Reading Below
Advertisement - Continue Reading Below
Advertisement - Continue Reading Below
Name

About,6,Anniversary,35,Apology,59,Appreciation,37,Birthday,62,Blog,43,Bookshop,19,Celebration,46,Christian,12,Christmas,23,Condolence,17,Congratulation,57,Contact,6,Disclaimer,6,Engagement,10,Independence,10,Insurance,160,Love,96,Meditation,24,Messages,69,Miscellaneous,42,Months,28,Motivation,39,Movies,115,Odyssey,117,Paragraphs,62,Pet,5,Pidgin,15,Poems,101,Prayers,44,Privacy,6,Quotes,45,Relationship,82,Scholarships,15,Sitemap,6,Stories,28,Terms,6,Tribute,3,Videos,69,Wedding,20,
ltr
item
Poetic Messages – We Made Words Sound So Poetic!: Pidgin Love Poems for You to Share with the One You Love
Pidgin Love Poems for You to Share with the One You Love
Here are the best collections of Pidgin Love Poems for You to Share with the One You Love.
https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjMewGEEkR9qPaWx1Y10C-TjXRmPIGLlpJyuc05wop9USZW30yfFLZ0Uyg6guykwAbJ5sqYo9MpkgQsZ-018hdZvssrNiCdx6KdHTcesvOcKdol8jLJ8e0rSbnT-KKxF7BLoQUjSoGB5Upfh8xXqiaz1DQ_x3vyG7F3H04dRprpLZbTpIS5FQTy7g4G/w640-h426/pidgin-messages.jpg
https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjMewGEEkR9qPaWx1Y10C-TjXRmPIGLlpJyuc05wop9USZW30yfFLZ0Uyg6guykwAbJ5sqYo9MpkgQsZ-018hdZvssrNiCdx6KdHTcesvOcKdol8jLJ8e0rSbnT-KKxF7BLoQUjSoGB5Upfh8xXqiaz1DQ_x3vyG7F3H04dRprpLZbTpIS5FQTy7g4G/s72-w640-c-h426/pidgin-messages.jpg
Poetic Messages – We Made Words Sound So Poetic!
https://www.poeticmessages.com/2020/02/pidgin-love-poems-for-you-to-share-with-the-one-you-love.html
https://www.poeticmessages.com/
https://www.poeticmessages.com/
https://www.poeticmessages.com/2020/02/pidgin-love-poems-for-you-to-share-with-the-one-you-love.html
true
4455371293229428714
UTF-8
Loaded All Posts Not found any posts VIEW ALL Readmore Reply Cancel reply Delete By Home PAGES POSTS View All RECOMMENDED FOR YOU LABEL ARCHIVE SEARCH ALL POSTS Not found any post match with your request Back Home Sunday Monday Tuesday Wednesday Thursday Friday Saturday Sun Mon Tue Wed Thu Fri Sat January February March April May June July August September October November December Jan Feb Mar Apr May Jun Jul Aug Sep Oct Nov Dec just now 1 minute ago $$1$$ minutes ago 1 hour ago $$1$$ hours ago Yesterday $$1$$ days ago $$1$$ weeks ago more than 5 weeks ago Followers Follow THIS PREMIUM CONTENT IS LOCKED STEP 1: Share. STEP 2: Click the link you shared to unlock Copy All Code Select All Code All codes were copied to your clipboard Can not copy the codes / texts, please press [CTRL]+[C] (or CMD+C with Mac) to copy